🤣🤣 even me sef shock for the vibes especially the chei chei and rasta additions. I dey suspect say Gifted @starstrings01 put weed inside the food wey I chop🤣
Abeg no go back to that your roots oo, something wey baba God don try bring you come out from, you wan come enter again...haba no be so oo comrade. Abi no be Iya Osun meta be your roots again🤣🤣
Hope say the pendant no sha blind you oo cos na wetin go happen las las if you try any risky move.
Sis. Gladys, thanks for always dishing it out differently. Na OG you be aswear. Collect 2 bottles of ororo for your coconut head🥂
Make I run go check your post. I no say en no go pass Lauren Diagle, my sister from Nnewi🤣🤣
Bye before I turn here to comedy spot. Much love🥰🥰