Afritunes Wk#200 Higher By Tems Cover

in AFRI-TUNES22 days ago

▶️ Watch on 3Speak


‎Wats up my people, How una dey? Ehen! It's Afritunes wk#200 and I wan share one of my favourite 9ja songs wey I like to sing almost everyday hehe. This song na one popular song wey be like national anthem for my country people mouth, yes oooh and na one popular artist nai sing am too...
‎Te song name na "Higher" by the one and only Tems

‎E don tey since I last post cover song and e no good 😞. So I don talk say this year, I must take my singing seriously because na something wey dey give me joy all the time.
‎From learning a new song to how i take deliver am na the process wey I love the most ehn.
‎Honestly, music na something wey just dey very important and beautiful to me because las las, no be everybody go fit still run this singing thing, but me I fit do am wella so I'm highly blessed ( if you no hype yourself who go hype you?) so my fellow musicians for this community, abeg hype yourself oo.

‎The song wey I dey do this week na very simple song and I sure say you go like am wella, so sit tight and enjoy...
‎I sure say some of una dey wonder why I dey blow pidgin up and down for this post hehe. My brother /sister,no forget say na Afritunes community be this and pidgin na our tongue so what better way to represent ? .... I sha hope say I don answer that your question 😊


Lyrics

Tell me why you're crying now kini big deal
‎When you gave me something I don't really feel
‎But you knew that already
‎When I found you on the ground you were dying
‎Now you come into my yard, uninvited
‎Can you see me on the edge, I'm enlightened


source


‎No forget to upvote, and also leave your comment on this post😉

‎Oya thank you for stopping, we go see again for this community next week 😎❤️


‎The cover image na my own


▶️ 3Speak

Sort:  

Wait first... How dis song take be anthem? E be like na different country me I dey oo. Cos I don't even know the song.
😅

I love how your caption was written solely with pidgin, I think I'd do that with my posts too.

Las Las, you don motivate me. I need to resume posting again oo. Itaff tay too.

Weldone Senior Woman. More Grace.
✨✌🏾

Which side of the country you dey?? Na anthem for this side oo, anywhere you sing am, people dey to back you up lol😂

Thank you my senior oga, I appreciate the comment 😊
You sef follow for the people wey backslide for this music thing small😂, do come back oo, me I don resume 😂

Awesomeness! Love how you performed the song, although I didn't totally understand your captions :)

!LADY


View or trade LOH tokens.


@ifarmgirl, you successfully shared 0.1000 LOH with @meyateingi and you earned 0.1000 LOH as tips. (1/35 calls)

Use !LADY command to share LOH! More details available in this post.

Thank you!!🤗
Happy New Year ✨🎊, so glad to see you here on my blog 😊

The post is written in pidgin English (it's mainly Nigerian slangs😅)