You are viewing a single comment's thread from:

RE: AFRI-ANNIVERSARY - Bianule (come and see) by @Jessicaossom

in AFRI-TUNES2 years ago

Someone is leading me into temptation sha. Shey you know say I be father of tagging and here you are telling me to tag people for you and appreciate baba @ksam. I fit tag people so tey the word count go pass the one of your post, hehe. Nevertheless I go still do am bcos Sam na my guy and he is doing well and secondly because I be obedient servant and anything wey dem say make I do l, I dey like do am perfectly.

Everyone should appreciate him for me. @jesus-son, @gloriaolar, @merit-ahama help me tag somebody to tag somebody to appreciate Ksam for me.

Therefore without much ado, I hereby comply with the request of my very good friend, @jessicaossom by calling on my ladies first, @chelsie-b , @jmis101 (u know say I must call you nah), @icyink (my new crush wey I never fit bold toast bcos of @ksam), my lady @maryjacy (for sure u must be mentioned), @marybello ,ehe, my another new crush @gloriaolar with a fine back, hehe. And many more of them(I just wan minimise apace. Then my guy @wizj, sir @tobbysax and so many others, 🙄(it is obvious I don't know many men, hehe) to appreciate baba @ksam for the sacrifice of delivering the t-shirt to Ossom and for other many good deeds of the young man. Baba may God bless you ooo

Omo make I leave all these talk talk make direct comment on your post.

Ossom my friend, you know you are good right? Anyways I don't know if someone has told you before, but I am doing that now. Omo you too good abeg. I just dey imagine say u be my sister, chai, I for happy like mad. I enjoy this presentation like mad. My two hands dey up for you walahi 🙌🙌. Nice work here for us to celebrate the afri-versary.

Happy celebration to you dear.

Ehe I been wan forget @hopestylist (how can I do that, when I know say she dey hard me get, at least this one fit be a means for me, hehe). I for add @merit.ahama but @hopestylist go tell am and so e go scatter plans as them be sisters.

Abeg make I come dey go, I don too talk, ah ah

Una happy celebration ooooo

Sort:  

😂
You are so funny.
I appreciate the tags, at least all of dem will come and join me thank Ksam for being o generous and kind

Thank you for your friendly and excellent comment Jesus-son.
Thank you and Happy Afri-Anniversary to you.

You are welcome dear
Enjoy

Awwwwwn
Ayam blushing oooo 🙈🙈🙈😭😭😭

😄😄

see long Note 😂😂....
No imagine @jessicaossom as you sister jor, just talk wetin dey your mind make we know.... make I come dey go.

😄😄

Chai see people sha o. U wan com cause trouble den waka comot. Sha u no lie sha o, I been get another thing for mind, but no tell anybody o, hehe

You dey mind am 😅😅😅

Lover of many women, you are doing well.
Keep up with the long cool comment and tags, mey dem no sha fight you oo.
Boss @ksam you have done well and is still doing marvelously well.
Congratulations dear @jessicaossom keep being amazing.

Thank you Jmis.

You are welcome dear

Eeeeh my lady, I know say u must respond, na why i no hesitate tag u. But wait o, I never see your entry for @afri-versary o. Abeg Roger am sharperly

😂😂😂
I didn't read much about it.

I no understand, so are u saying u shouldn't expect anything from you??

Yes

Hahahah
Lover of many women
Ghen ghen @jesus-son dem don see you finish 😅😅😅

Thank you so much haunty 🥰

My God will judge them all 😅😅

Nothing to judge here sha🥂

Ah!! Na u talk dis thing??
I think say u dey with me

😂😂😂😂
Lemme eat first

Lolz

Yes, he is.
You are welcome huncle

Boss!!!😅😅😅😅😅....
This man dey single handedly shake this community 😂👐🙌...but you nor lie sha....this rendition is just Superb!!💯
She did a great job ...we know we'd get there too someday...abbi na??? @jesus-son .

an amazing Presentation my dear...
Your contents has continuously caught my attention...if this happens again, I go drag you from @jesus-son reach be that😄👐😉.

Happy Afri-anniversary dear...

Hehe, omo dis one is taken oo, so no draging at all

My brother true true we go reach there one day

Tanchu for responding to the tagging, you too much

Lol. You are just so funny. Great job

Tanchu ma

You are welcome sir

No sha near icyink 😅😅😅 thunder dey do press up
Lol

😅😅
Silent mode activated